You be nepo, we be lapo
We no fit do like you o
Because your leg long pass pole
If we do like you, we fit die!
If we chop once a day,
Na privilege
If you do the same thing,
Na intermittent fasting
If you be learner wey slow,
Na slow you slow
If to say na we, we be olodo
If you fuck up,
Second chance plenty like water
If we fuck up,
O ti tan
If you break your papa’s property,
Na because say you get anger issue
If to say na we,
That one sef na issue
Wey them go solve with ẹgba tírín.
Na we sabi hunger packs
Na six packs you sabi
You think say we equal abi?
Igi imú jìnà sí orí
You fit wear hoodie go sign contract,
We no get choice but to borrow suit
The koko be say finger no equal
Your own na middle finger
And our own na little finger.
Ayankola Ahmed is a student of law at the University of Ilorin with a keen interest in the world of poetry.